Post Top Ad

Tuesday, January 14, 2014



FIFA PRO WORLD XI: SPANISH CONSPIRACY?

The FIFAPro World XI, wey dem announced on Monday for the Ballon d’Or ceremony wey take place for Zurich are made up of players from only four sides – Barcelona, Bayern Munich, Paris Saint German and Real Madrid.

E be like say e no easy for Bayern Munich and Paris Saint German to get players wey make the first eleven because one of the criteria for selection na to play for either Barcelona or Real Madrid. Abeg ask yourself why na only La-liga players win am the last time.

 Now, we all know say it took 7 ogbonge goals against a Barcelona side wey get four of their players for FIFA11 and a Champions League trophy for three Bayern Munich players to be among the first eleven players wey sabi. Paris Saint German sef hustle buy a player wey cost too much money and salary for them to fit put one of their player for FIFAPro11.

We are yet to see what Barcelona did to merit four slots in FIFAPro11 after loosing 0-7 to Bayern Munich. Please don’t tell me they won the league. Manchester United and Juventus won the league and we no see players like Van Persie and Andre Pirlo for the list. Abi no be the same league them win? Una know say Pirlo never dey the list since 2006 because na Xavi and Alonso dey occupy him position? Last football calendar year was one of the worst year in Xavi’s game. But it was also one of the best year for players like Pirlo and Yaya Toure. Yet Xavi name dey kamkpe for the list. This na weiting some people dey call Spanish conspiracy.

We know say Ronaldo na the man wey sabi, and him suppose dey among the eleven wey sabi. But na weiting players like Ramos dey do for there? Someone even say maybe na because na him make the highest number of interceptions for world cup qualifier. So una see say FIFA or their voters dey look for any and every opportunity to give this award to Spanish players or players wey dey ply their trade for Spanish league.

We feel say FIFA suppose spell out the criteria wey them dey take measure how good a players is so that we go know weiting make all this players dey win am. This criteria go even help us understand why na only Yahin be the only goalkeeper wey don win World footballer of the year award wey the likes of Oliver Kahn, Michael Schumacher, Peter Schmichael,  Bufon, Casilas and even Victor Valdes never ever smell am. E go even help us know why Nicklas Bendtner never win Ballon d'Or wey Messi and Ronaldo dey win am.

But on a serious note, Spanish players like Ramos dey make us ask why him dey for the list even for the year wey Real Madrid and Spain no win anything.

Una see why we think say na Spanish conspiracy be this?

No comments:

Post a Comment