080lens don catch Pep Guardiola dey manhandle him player. Abeg
make una see as the 43-year-old coach carry him hand push the German world cup star,
Thomas Muller for chest. Guardiola no stop there oo. Him put two of him hands
for Muller neck and shoulder. Common pep! These players no be small children
oo. Na person papa you dey push so oo! Go down low and see the pictures
Oga pep first dey hala Pizarro for Bayern training. See as people dey watch
Oga Guardiola leave Pizarro come face Thomas Muller. See him hand for Muller chest.
No be small thing oo. Guardiola don grab am for neck. Other players just pretend like say then no see am. If you talk? you go sit down for bench!
Respect to Thomas Muller as him just leave Guardiola with him wahala. Guardiola for see nwee if to say na Mario Balotelli him treat like that.





hahahhahahahahahah...... come on... there is nothing in this na...
ReplyDelete