Manchester United start competitive game under Van Gaal in a
terrible fashion. Them loose for their house. Draw Sunderland wey no get
striker away and come succumb to a devastating loss against MK Dons. But Man U
problem dey many and Van Gaal na one of them.
THEIR
BIG NAMES NO DEY DO ENOUGH TO JUSTIFY THEIR NAME
Rooney, Van Persie and Mata na one of the biggest names for EPL.
Rooney na the highest earner for EPLand Van Persie dey follow am for back. But
these players no dey do enough to justify their price tag, take home pay and
their reputation.
INJURIES
We know say United no dey try these days, but injuries
follow contribute to their willi-willie football. Luke Shaw, Carick, Chris
Smalling, Ander Herrera and Jesse Lindgard dey for the side lines. Maybe we go
see the ogbonge United when these players comeback from injury
ALLOWING
DAVID GILL TO LEAVE AT THE SAME TIME WITH SIR ALEX FERGUSON
All of us know say Sir Alex Ferguson na legend. But David
Gill na the reason wey make him do wella during him last days. Say Monkey sabi
jump na when tree dey nearby. Gill try get every player wey Ferguson want. But
Oga Ed Woodward no too try at all.
FAILING
TO SIGN FABREGAS
All of us see how Fabregas start this season like house wey
dey catch fire. This na why everybody dey imagine weitin for happen if to say
Manchester United snap am up. Mata na downgrade to Fabregas.
ZERO
CONFIDENCE
The Old Trafford swagger levels drop since the time of
Moyes. And their start to life in this current campaign no help matters at all
at all. Make we believe say uncle Di Maria go help lift them up.
ZERO
FEAR FACTOR
Hello? Na who dey fear Manchester United? Anyone? Ok. No
one. But them get time when big clubs dey fear to come Old Trafford. Even
Mourinho wey don win plenty times for Old Trafford still carry defensive line
up come there last season. But no be the same thing today. Small clubs like
Swansea dey even show face for old Trafford with the expectation of not only
getting something from United. But collecting everything from.
VAN
GAAL WAHALA: NO FORMATION
Abeg make una tell Van Gaal say him obsession with 3-5-2 no
go end well for United based on their current squad. If them dey collect ontop
Swansea and MK Don head, just think weitin go happen when them face Chelsea,
City and Liverpool.
NO
CENTRAL DEFENDERS
Van Gaal no get plenty ogbonge central defenders to choose
from after the better ones waka go other clubs wey show early interest for
them. Rumor dey waka come our ear say the remaining good ones like Hummels don
sign new contract with their respective clubs.

No comments:
Post a Comment