The news say we don sign Di Maria no be news again as him don bid farewell to him former team mates for Real Madrid. We no go state the real and true price wey we take capture him signature until we formally unveil am. Abeg no believe all these figures wey dey make the rounds for media. This post no be about the player wey we don already sign. This na about another ogbonge midfield juggernaut wey dey juventus: Him name na ARTUROOO VIDAAAAAL
The news wey dey waka come reach our ear be say Manchester United want take their spending spree to the next level by securing the signature of Arturo Vidal for a reported 32 million pounds. Them say them say talk say the only thing wey dey delay the deal na him kneel wahala. Them also say Manchester United wan use appearance fees and other related clauses take protect their own interest. Them say a deal will be announced before the closing date of this transfer window.
DI MARIA, MATA, VIDAL AND HERERA MIDFIELD
Abeg sit down, cross leg, sip water and imagine a Manchester United midfield of Di Maria, Mata, Herera and Vidal. Just imagine how we go get a combination of speed (Di Maria), Vision/Pass (Mata), and Steel (Arturo Vidal). Our midfield go close eye boss other midfield for EPL and even Champions League.
BLIND AND CO SET TO JOIN THE PARTY
Manchester United news no stop for Di Maria and Vidal alone oo. Them say them say talk say Blind and other ogbonge defenders go soon show face for Manchester United. Them talk say we go conclude the signing of one or two defenders before this transfer window close. All these news show say Manchester United still be Ogadagidi brand wey fit attract ogbonge players even after our recent misfortunes.
GOOD NEWS ARE HERE AGAIN
Abeg no listen to nay Sayers wey dey talk say Manchester United own don kpafuka just because we lost a match and drew another one away to a Sunderland wey close eye arrange Chelsea for Stanford Bridge. We know say we no too bam at the moment. But with the news of all these incoming players, Manchester United no go only make top four. Them go even contend for the title.

No comments:
Post a Comment