La-Liga don start and the top clubs and major boys don dey show themselves
already. Real Madrid win 2-0, and Barcelona open their own with a 3-1 win. Even
the players no want wait till the season go far before them show weitin them
sabi do as Messi don arrange two and Ronaldo don introduce himself with one
goal. Now make we look how this La-Liga
season go shape up.
TWO HORSE RACE
We believe say La-Liga na between Real Madrid and Barcelona.
Atletico Madrid go dey around but them no go fit do back-to-back La-Liga win after
losing Costa and Felipe Luis. Them don do well to win a trophy already.
LA-LIGA GAME CHANGERS
All the players wey dey Madrid and Barcelona na game changers
them be. But Ronaldo, Messi and Suarez na Supper game changers. These players
go show themselves when Real Madrid and Barcelona meet each other for
El-Classico. And the way wey these two clubs take start their La-liga campaigns
show say El-Classico go be major factor in determining who go win La-liga title at the end of the
season.
NA WHO GO WIN AM?
This na question wey dey very difficult to
answer and na for this same reason we no go categorically tell una say na
Madrid go win Li-Liga only for our oga at the top to come say na Barcelona. But
one thing dey sure. We go know who go win am at the end of the season.

No comments:
Post a Comment