Recent discussions like James Rodriguez's move and him shirt sales at Real Madrid and other previous discussions; like how Real Madrid take dey make the money wey them take sign Cristiano Ronaldo and David Beckham on shirt sales alone lead the 080football crew to write this article on shirt sales and their true worth. Make una enjoy this educative piece.
SOME QUESTIONS
Before we waka go front for this discussion, make we ask the following questions wey go make us understand the subject matter well well; How many shirts Clubs dey sell, How much clubs dey make from each sale, Na which player dey sell the highest number of shirts, the average number of shirts wey clubs dey sale before them buy big named player dey increase? Abi e dey remain the same. All these na the questions wey we go try answer bellow.
THE ANSWERS
The highest jersey-selling club na Real Madrid with an estimated annual sales of 1.5 million jerseys and the lowest among the big clubs na AC Milan with an estimated annual sales of 350,000 shirts. The average amount wey each club dey get (from each jersey sale) for having their badges in front of their shirt na 12 Euros. Critiano Ronaldo na the highest shirt seller. Him dey average 1 million jersey sales per year. Every club jersey sales dey increase as their fan base dey increase. Big name players no dey increase fan base well well even though them dey sale jersey well well. Them dey increase jersey sales because fans dey leave other players jersey to buy their own. Take Madrid for example; Them dey average the same number of jersey sales per year before and after them buy Cristiano Ronaldo. Abeg no confuse big name players with regional ones. Regional players dey increase fan base and jersey sales. Mohammed Salah and Kagawa na regional players, while Cristiano Ronaldo na big name player. Manchester United jersey dey sale well well for Asia because of Kagawa. Him dey among the top ten jersey sellers in the EPL.
MATH VS MYTH
The myth na say some ogbonge footballers dey generate their sign up fee and annual salary with their jersey sales. But the math show say e dey impossible because the total jersey sales in every club no reach the salary of their highest earner. Since Real Madrid dey sale 1.5m shirts, and them dey make 12 Euros per shirt. E mean say the money wey Madrid dey make from shirt sales alone na 12 multiplied by 1.5 million = 18 million Euros. 18 million Euros no reach Ronaldo current salary. No forget say addidas and other kit manufacturing company dey pay Clubs an average amount of 20 million Euros per annum for the exclusive right to manufacture their kits and place their logo on every kit wey them produce. Add this money to their jersey sales and to the amount wey their sponsor dey pay, you go find out say e still no reach to pay 10 percent of the salaries of their players.
CONCLUSION
Clubs dey collect around 12 million euros from companies to allow their logo on their shirts. Chelsea collect 14 million Euros from Samsung. We know say 8million to 18 million Euros no be small money, but the impact wey shirt sales dey get on club revenue dey grossly overestimated. This na why many people believe say Ronaldo and Messi shirt sales alone dey enough to pay their salary. We don show una say all these talks na wrong assumption. Make una stay tuned as we go continue to dey educate una on football matter.
Una bye bye for now.

No comments:
Post a Comment