In 1986, one Diego Maradona handled the ball “brilliantly”
to beat Peter Shilton. The referee
turned a blind eye as Argentina cruised on to win the world cup at the expense of England. Maradona later
dubbed it the “Hand of God”.
Saturday’s Chelsea vs Arsenal game saw Oxil Chamberlin doing
the same thing when he stretched at full length (to the envy of Cech, Buffon
and every good goalie out there) to save a goal-bound Hazard shot. Don’t get it
twisted. Chamberlin no be the goalkeeper
of the day oo. But him manage to do a better job than Wojciech Szczesny (wey
concede 6 goals) in making sure say the ball no enter net.
But this one no be the main gist.
The referee of the day, Andre Marine, rushed to
the scene, brought out his redcard, look Chamberlin for eye, look Gibbs for nose.
Dish out the redcard to Gibbs. Chamberlin run meet am. “Oga Ref, na me you suppose give the
redcard because na me take my hand parry the ball inside 18 yard box” but
the referee look Chamberlin. Shake him head in a way wey suggest say “ pack well jor! e don tay
wey I dey do this work. I sabi am pass you. I know who use him hand commot the
ball”.
Why many and plenty
referees dey commit this kind of blunders sef? Una never forget the way wey Fray take
make Chelsea loose three crucial points against Villa. Or the way wey Akinson
take dash Chelsea the goal wey them take win United. What about the way wey Ovrebo take use whistle
pursue Chelsea from Champions league Semi final? And the way wey Howard Web
take kill Arsenal unbeaten record against United in 2005.
Referees don dey mess things up for a long time now and nothing dey happen. And we feel say the time don reach wey some body go vex bring out him red card. Dash the referee wey no sabi him work.
Abi na lie we talk?

No comments:
Post a Comment