Bayern will host Manchester United in Munich this evening
and the whole world dey expect make Bayern arrange United wella wella. But
United fit win this game if Moyes tinker here and there and maintain some of
the things wey dem do well for the first leg. This na weiting we dey suggest
make them do
FERDINAND AND VIDIC
NEED TO REPEAT WEITING THEM DO FOR THE FIRST LEG
Rio Ferdinand and Nemanja Vidic rolled back the years in the
first leg as them marshal out the defense of Manchester United wey hold Bayern
kwitchi kwom! Now them must do the same thing if them wan win today.
FELLAINI MUST DO
BETTER THAN HE DID IN THE FIRST LEG
Fellaini no try for the first leg as him just they run like
person wey dey pursue fowl. Moyes need to tell am make him put him head for
ground, cool down, drink water and time him tackles perfectly. E no go sweet
United belle if them go one man down oo.
PLAY ROONEY UP FRONT
Moyes need to get the perfect mix of players for midfield
and attack. Him also need to play Rooney upfront. We hold this view because we
know say Bayern no go give United many chances and Rooney no go chop chances
when them present their selves. Him also get the ability to convert half
chances into ogbonge goals.
But Bayern na them be the poyon poyon for this game and them
get the coach wey sabi. Every United fan need to pray make...Ok, make I stop
here for now. See you after the match.

No comments:
Post a Comment