Post Top Ad

Friday, April 11, 2014

TODAY IS THE CHAMPIONS LEAGUE DRAW



Today na the Semi Final draws of UEFA Champions League and UEFA Europa League. Both Draws go shelle for the same House of European Football in Nyon, Switzerland.

REAL MADRID VS CHELSEA?

Many people want make Real Madrid meet Chelsea because of the perceived feud wey fit exist between Mourinho and him former club.

REAL MADRID VS ATLETICO MADRID?

This na another ogbonge pairing because of the derby wahala wey go shelle if them meet again. We all see the gwege wey happen when Real Madrid comot Atletico for Copa del Ray semi final.

BAYERN MUNICH VS CHELSEA FOOTBALL CLUB

This na another important one wey fit happen because na Chelsea collect the cup for Bayern Munich backyard.

Make una stay tuned. Everything go happen around 11am. We go keep una updated.  


No comments:

Post a Comment