The world cup don dey approach the knock out phase and we
want make all of us waka round the country wey we feel say go win am. Make una
enjoy.
NETHERLANDS
Netherlands be the number one to win this world cup after
them arrange the defending champions 5 goals to 1. Their defence bam and their
defence-to-attack transition arrange wella plus the form wey Robben dey- no be
here oo. RVP no dey show mercy whenever him see ball near the 18yard box. The
defence na their major weakness. But their mentality na their major strength.
BRAZIL
Na their home country. The fans dey behind them. Neymar dey
ogbonge form. All these fit make them win am. But their major weakness na
defensive lapses due to the lack of concentration and communication wey dey
exist between David Luiz and Thiago Silva. These defensive frailties surprise us because
Luiz and Silva be the most expensive defenders in world football.
GERMANY
Ghana (a side wey sabi run pass Okada) clear the German machines abi german power bikes eyes wella after them manage a draw
against a dem . But we no suppose forget say Muller and the rest of the
German side na National side performers, Them dey always deliver in their
National colors. The other good thing be say the German team no get any major weakness but also them no get any major player wey fit change game like Suarez and Messi.
ARGENTINA
Argentina never live up to their billing after
them struggle against Iran of all teams. Them also refused to turn up when them
meet Bosnia. But them get one major factor wey fit win match: THE MESSI FACTOR! This guy fit
change any game in split seconds. And na time go let us know weda Messi na the
Super Man wey fit gift the world cup to Argentina. BTW today na Messi baiday ohhh...Make e no use Najia catch bday groove 2momo shaa.... Nothing to fiaa!! we don sign sign up for "Enyama Savings Account" for FIFA bank" .. see ginger!!!!

No comments:
Post a Comment