One of the things wey we hate about international breaks na
lack of news and activities. The bad part of it na the fact say Naija club
sides no play football due to the wahala wey dey shele for NFF. But we still
manage to squeeze out some juicy gist to keep you informed and entertained.
Enjoy!
THE DI
MARIA SHOW
Di Maria show say him worth every penny and kobo wey United spend as him lead
and orchestrate the plan wey fall Germany hand. Him assist three goals, add one
goal to him name to warn premier league clubs wey think say United own don kpafuka
MAIGARI
IS BACK IN NFF
This matter tire us no be small as Naija just dey act
Nolywood movie on top our football. The good thing be say FIFA no go ban Naija
since we don dey obey weitin FIFA say make we do. But the bad side be say we no
dey learn anything at all. Maigari don show. Chris Giwa don step down. Them go
conduct another election. We also urge the referee association of Naija, the
state FA chairmen and every stake holder wey dey on strike because of the
wahala to come back make we continue our league this weekend.
ENGLAND
STILL ENGLAND
England still never know where ant bite them as them still
dey run from pillar to post playing nothing. Thank God for soft penalties and a
prolific penalty taker wey be Rooney. If not, England for no fit bit Norway for
Wembley.
THE
NEXT GENERATION OF SPANISH SUPPER STARS
Them Xavi, Alonso, Vila, don waka go. Other ogbonge stars like
Silva, Fabregas and Costa don fill their position. The big surprise na Juan
Mata wey no make the current squad. United fans go dey pray make Vicente De
Bosque dey joke when him say these current players na the future of Spanish
football.
SUPER
EAGLES VS CONGO
We go play Congo on Saturday. This na why our Coach wey sabi
dey drill our players for Calabar. We want make sure say we win Congo wella.
Our inform forward, Ahmed Musa don dey hala how we go take arrange Congo. I
hope say all our players wey dey talk go carry their talk into the pitch.
Go Eagles!!

No comments:
Post a Comment