Nigerian football dey like a family where everybody wan chop, but nobody wan cook the food wey them go eat. Every time we dey ask ourselves weiting be Naija football. Is it the Super Eagles? Abi na the League? Maybe na our national teams or the Super Falcons? Many people no know say Naija football na our league just as England football na the EPL.
BOTTOM UP!
True football development dey always start from the bottom. E dey start from the league, then e go trickle down to the National teams. Before e even reach the Super Eagles. But our case for Naija different, Everything dey start and stop for the Super Eagles. This na why even the government wey no dey put their mouth for our local league matter, dey always put their hand for the National team. This kind thing must stop if we want meaningful football development.
THE SOLUTION
One of the solution na to go back to the drawing board, draw the thing wey resemble our local league and leave the Super Eagles to grow naturally. We need to start to dey show passion for our local league. The government and politicians go always gravitate towards weitin the people like. This na why we dey see posters where politicians dey claim to be fans of clubs wey dey EPL and La-liga. Them dey do this because the people identify with those European clubs. 080Football dey tell una say if Nigerians identify and love our local football, all stakeholders including corporate Nigeria and our politicians go also love and invest in it. Make una see how Kano Pillers dey survive in the corporate and political world because the people wey dey Kano love the club.

No comments:
Post a Comment