Chelsea na club wey sabi welcome their own and them don welcome
many of their players wey comot from their club. Them even go a step further to
clap for Lampard when him score the goal wey take two points from them at the Etihad. But a
lot don change. This na why we dey tell una why Chelsea no go too welcome
Lampard when him show on Saturday. Enjoy.
LAMPARD CONTRACT MESS
Lampard give him 13 ogbonge years for Chelsea and him
deserve plenty respect. But e be like say him lie to join a direct rival. Him
say na a club for MLS him dey go and him go only dey Manchester City just to
train till MLS start their season. Only for him to take a detour come become
permanent resident for Manchester City. Even Wenger wey dey respect Lampard
lend him voice say Manchester City scam EPL FFP rules.
Strange sight as Lampard dey for City colors.
LOYALTY
We know say Chelsea no offer Lampard another contract when
him tell THE SUN say; “I would have obviously stayed at Chelsea if they had
offered me another year. There was no reason for me to leave. The decision was
made and I don’t know who made it.” But e for dey easy if to say
Lampard tell everybody say him dey go Manchester City from the beginning instead
of going to Manchester City via a club wey dey for MLS. Ashley Cole and Solomon
Kalou also choose Clubs outside EPL out of loyalty and respect for Chelsea and
their fans.
Cole and Kalou no join Spurs because them be Chelsea rival
We assume say Lampard romance with Chelsea never end and any
fan wey dey para say e don end need to checkout the role wey Lampard play for
Chelsea FC history. But the truth be say, Lampard no do like Drogba wey
comeback to Stamford Bridge with a smaller club. Him dey come back to Stamford Bridge
with the only club wey fit rest the title out of the hand of Chelsea. This na
weitin 080FOOTBALL dey call FOOTY SIN.
No comments:
Post a Comment