Post Top Ad

Thursday, February 26, 2015

ARSENAL! ARSENAL!! ARSENAL!!! NA HOW MANY TIMES I CALL YOU???


Nobody expect bush meat to catch the hunter. Nobody expect the police to go to prison. Nobody expect the under-dog to beat the dog (Oga) at the top. We no expect Monaco to arrange Arsenal like say them be kwulikwuli wey dey inside Ijebu garri. This na why Arsenal fans face dey like Mr Ibu own. This na why them dey shout: ARSENAL! ARSENAL!! ARSENAL!!! NA HOW MANY TIMES I CALL YOU???
Arsenal started the evening like bunch of players wey forget their playing boots for house. Sometimes we feel say them expect Monaco to respect them because them be Arsenal.1-3 no be good result against a Barcelona or Real Madrid side away. Let alone a tatcheri Monaco side at home.

Arsenal fans no go blame Wenger this time around. Them go blame the players wey refused to play football. These players don give Arsenal big-tall mountain to climb. Now them need to score at least 3 goals against a Monaco side wey get ogbonge defensive discipline.

But Arsenal don do am against the Inter and AC Milans of this world. Maybe them go do am against AS Monaco. 

No comments:

Post a Comment