No be news say Ivory Coast win Ghana via penalties for the
just concluded African Cup of Nations. But when we look at the golden
generation of Ivory Coast and this current Ghanaian team, we go see a lot of
similarities. The same similarities wey exist with our own golden generation.
Maybe na coincidence say the two countries wey play final
carry foreign coaches come. After all, Naija win am with Stephen Keshi wey be an
indigenous coach. But one thing dey sure, Naija win am without pattern or
development. Everybody see Ivory Coast nose dey sniff around the title for a long time now. Now Ghana don
dey do the same. But na weitin these two countries dey do well wey Nigeria dey
do wrong?
THE FAILURE OF OUR EX-INTERNATIONALS
The ex-internationals for Nigeria feel say the Nation owe
them something after their meritorious services to Nigeria. So them dey always
rush down to take up coaching jobs without proper learning process. History get
am say NONE of our ex-internationals don do well for our local clubs. Even oga
Adepoju no try for 3SC and the same as Siasia when him coach Heart Land. Our
ex-internationals need to get national coaching jobs because of their
qualifications and pedigree, no be because of their reputations as former
internationals.
LACK OF PROFESSIONALISM AND POLITICAL INTERFERENCE
Many politicians dey leverage on Football because na the
sports wey dey unite Nigerians. This unfortunate reality dey affect Naija
fooball negatively as we dey see how politicians dey influence coaches
appointments. Even for club level. Some Nigerians believe say some unseen hands
force the hands of NFF into re-appointing Keshi. Some believe say the NFF hierarchy
want appoint a foreign coach or another Nigerian.
THE WAY FORWARD
We need to strengthen our academies. Clubs like Kano
Pillers, Enyimba, etc need to get well structured academies to breed more local
talents. Scouts needs to do a better job to identify young prodigies. Above
all, our football administrators need to arrange and erect the structure wey go
dey always identify young talents from secondary and even primary schools.

No comments:
Post a Comment