Post Top Ad

Thursday, April 03, 2014

ITS MATCH DAY 4: LETS TALK ABOUT THE NAIJA PREMIER LEAGUE


The Nigerian Premier League don reach match 4, and na Akwa United be the Oga at the top of the table. Victor Nemo of Akwa United na the equivalent of Premiership League Suarez with 4goals in 4games. Not a bad statistics if una consider say the all time highest scorer for Naija dey less than 22 goals.

ENYIMBA LOST A DERBY AT HOME TO ABA WARRIORS
Newly promoted Aba Warriors shocked the whole world when dem defeat Enyimba 1-0 for Enyimba home. Now, we go watch how the away win go give them the needed momentum to win and stay up this season. Good days are here for the warriors of Aba.

HEARTLAND NOT TOO GOOD THIS SEASON
Heartland dey 19th position for the league table after playing all the four games this season. Not the best of times for the Nazi Billionaires wey no dey score many goals. na only 2goals dem don score. them even concede 4. Them go need miracles to win anything this season.

The league still dey very fresh and some Clubs never play some games yet because Nigerian League Management Company been bar Nembe City and GiwaFC from playing. But them don lift the ban on Giwa FC now nd dem don resume play. Hopefully we go see dem nembe boys soon.

We go dey update una as the games dey roll out.

No comments:

Post a Comment