We expected PSG to win yesterday’s game. But no be with the huge
3-1 margin wey them take win am. We expect say Chelsea go hold their ground and reduce the deficit
to a winnable minimum. But now, them don give them selves big mountain to climb
when them host PSG on Tuesday next week.
MADRID IS THE TEAM TO
BEAT IN THE CHAMPIONS LEAGUE
Ronaldo, Bale, Di Maria and many more ogbonge players make
am very difficult to win Madrid. Them be the most complete team from defense to
attack. Bayern good, but them dey show defensive frailties like them do against Manchester United. Same with
Barcelona. This na the reason wey go
make Real Madrid win am this season.
THIS NA THE BEST TIME
FOR REAL MADRID TO WIN THE CHAMPIONS LEAGUE
This na the best time for Real Madrid to win am. If them no
win am, e go dey more difficult next season when Pep Guardiola and Jose
Mourinho finish working on their team. Them no get better player wey go
improve any playing position for Real Madrid next season, except maybe Suarez or Aguero. But Chelsea go dey
more dangerous with a striker, a player to pair Matic and a left back. Same with
Bayern when them buy defender wey sabi. So make Madrid win am now ooo.
MOURINHO WAS RIGHT!
CHELSEA BE LITTLE HORSE
We all know weiting Mourinho dey preach at the beginning of
the season. Him dey say Chelsea na little horse wey dey learn how to run and
jump. This na the reason wey make them loose that game yesterday. Imagine the
contrast wey exist between the game wey Chelsea play Arsenal and the one wey
them play Crystal Palace and PSG? The lack of consistency show say them be
learner
CHELSEA WILL BE THE
TEAM TO BEAT NEXT SEASON (EVEN IN THE CHAMPIONS LEAGUE)
A striker who knows how to find the back of the net, a better
midfielder to pair Matic and a left back na
weiting Mourinho need for world
domination. Trust Mourinho to make Chelsea very difficult to beat. Happy times
go soon come. Make una no vex too much oo. All the Chelsea fans them.

No comments:
Post a Comment