We don watch as Mikel role dey diminish from the all
important one to a mare peripheral one since the return of the special one.
We know say Mikel still sabi and him fit walk right into the first eleven of many top Clubs in Europe. This na the reason why we feel say time don reach make him waker comot for Chelsea Football Club.
We know say Mikel still sabi and him fit walk right into the first eleven of many top Clubs in Europe. This na the reason why we feel say time don reach make him waker comot for Chelsea Football Club.
THE MATIC FACTOR
Mikel skill set no fit the current counter attacking 4-2-3-1
system wey Chelsea dey play. Mourinho need a faster defensive midfielder (Matic), wey fit
convert defense to attack at a faster rate than Mikel. All
of us know say the defensive midfield no be Mikel natural position even though
him dey try wella for that position. And we also know say Matic better pass am for defensive midfield.
But him fit play more like Alonso and Pirlo for another club wey get a more flexible system like the 4-3-3 and the 3-5-1.
JUVENTUS, INTER
MILAN, ATLETIC MADRID, DORTMUND LINKS
We all know say Chelsea reject advances for Mikel services from all the clubs
wey I mentioned above and many smaller clubs without Champions league football
like Tottenham and Everton. We feel say him need to go to Juventus as them want
make him replace Pirlo. Juventus go fit match him weekly wages and their
flexible 4-1-3-2 and 3-2-5 system go suit Mikel style well well.
SERIA A IS SLOWER AND
SUITS HIS STYLE
Every player and League get their style. Pirlo probably fit
be flop for EPL because him no be the fast kind of player and EPL no be league
for slow players. That na why many people no see Kanu and Barbatov as big EPL
stars. Mikel need to chose a slower league like Seria A and La-liga wey rely mostly on slower and more creative
defensive midfielders wey fit hold the ball and pick out good passes. This na why we feel say e go do both Chelsea and Mikel a lot of good if them part ways.
We go continue the mata with the reason why we feel say Moses suppose comot for Chelsea Football Club

No comments:
Post a Comment