Nigerians go hope say the Supper Eagles go dey Supper when
they meet Iran on Monday night (8:00 today). All no too arrange for Naija especially when
we consider the recent salary and bonus gbege between the Supper Eagles and the
NFF. We advise all the parties involved to sort everything out before the game.
DANGER MEN
Hassan Abdel-Fattah na their highest goal scorer when them
qualify for world cup. Naija players need to shine their eye where that guy
dey. The best way to mark Hassan na to cut off him supply.
Naija danger men na Emenike and Odemwinge. These two
ogbonge players go get a goal or two for Naija. Iran go try shine their eyes
around these players but them no go see anything.
KESHI VS QUEIROZ
Queiroz get big reputation after him assist Sir Alex
Ferguson for Manchester United. Him go square up against the African Champion, Stephen Okechukwu Keshi wey carry Togo and now, Naija go world cup.
Both coaches
go try to stamp their authority on the pitch with their tactics and game plan.
INJURIES
Iran no dey worry about any injury. But Naija no fit say the
same thing with Monaco left back, Elderson Echiejile out of the world cup due to hamstring
wahala . Oga Keshi get enough players to
cover that position.
PREDICTION:
This game no go dey as open as everybody dey think. We feel say the match go
end with one goal difference. With Naija having the upper hand.

No comments:
Post a Comment