All Nigerians
don see the 23 men wey go rep Naija for this World Cup. We also watch Naija 2-2
draw against a semi good Scotland side and our barren draw against a good Greece
side.
But one
thing wey we notice na the way wey we play for second half. E be like say our
game dey improve as our team continue to dey play together.
For those pepz wey
no know Greece Wella, them dey for 10th position for Obodo universe and we dey
only 45th position. So na “good thing” to play them draw.
The fearful
aspect na the way wey the other members of group F dey play. Argentina last
match na 3-0. Bosnia win their last two matches by a lone goal. The fact say
Bosnia and Argentina play 3-0, 1-0 and 1-0 for their world cup warm up matches
show say them be team wey dey score plenty goals and concede less goals.
THE SUPPER EAGLES NEED TO UP THEIR
GAME
We fit
qualify and even get good result against Argentina if we raise our game. Our
build up play dey very good. But we dey always make mistakes in the final third
with too many over hit and misplaced passes. If we fit get these part right, we
go do well for this world cup because we get players wey fit score goals and
defend very well.
SUPPORT THE EAGLES
Our
Supper Eagles and the entire African
team needs our support. So we need to throw our support behind them even if we
no get good results for early stage. We must play our part by supporting them
and hope say them go play their part by doing well in the field of play.
We say
Goodluck to the Supper Eagles of Nigeria and the teams representing the
continent of Africa.

No comments:
Post a Comment