Post Top Ad

Thursday, June 12, 2014

WORLD CUP THINGS: GROUP A



BRAZIL
CROATIA
MEXICO
CAMEROUN
BRAZIL

We go beam 080football torchlight on Brazil because even the pikin wey still dey their mother belle know say Brazil go come out the oga at the top of this group. This na because them dey play this world cup for their backyard and them get plenty ogbonge players pass every other country wey dey the group. Everybody expect Brazil to come first. Second na huge disappointment.
The players to watch na: Neymar, David Luiz, Oscar… and all eleven players wey dey their first team.

STRENGTH: Brazil strength na the understanding wey dem don build before, the fact say no major player dey injured, every player na VIP player for him club, and them get coach wey win the world cup and confederations cup when everybody write them off.

WEAKNESS: Them dey a bit short and thin for their striking department. Fred no go make any defender fear. But Hulk and Neymar go dey enough

CROATIA
This na another team wy dey beside Brazil as them carry the best striker and probably, the best midfielder for the group. Manzuikic and Modric better pass every striker and midfielder wey dey the group. Including the ones wey dey Brazil. Them go come second. Third na huge disappointment. First na overachievement.

PLAYERS TO WATCH: Modric, Mandzuikic and the new Barcelona man, Rakitic

STRENGTH: Modric  and Mandzuikic be the best players for their position as far as group A is concerned. Them fit cause serious gbege for any opposition.

WEAKNESS:
Na only Modric, Manzuikic and Rakitic waka come for Croatia National team. The rest just dey average and lack some sort of experience in big tournaments like World Cup and Champions League

CAMEROUN
Cameroon na another country wey dey struggle at the moment. Especially as them do Aluta say them no go enter plane if them no give them some of the money wey them owe them.

PLAYERS TO WATCH: Samuel Eto’o, Song and em em..make we just leave am for this two

STRENGTH: Eto’o na ogadagidi for plenty tournaments including the champions league. This na him fourth World Cup. Another plus na song wey don win La-liga with Barcelona

WEAKNESS: Their weakness plenty no be small. We no even know where to start. Eto’o no be the prolific striker wey him be before. Song na fringe player for Barcelona. The worse thing be say, na only Eto’o and Song waka come.

EXPECTATION: Third position, second will be a massive result and forth a big disappointment.

MEXICO
Mexico na  a country with homogeneous  players. Nobody stand out wella. From Chicharito, Carlos Vella, to Dos Santos. All players ability dey a little below average. But e don tay wey them dey play together.

STRENGTH
They are a team with good team play. And no obvious weakness.

WEAKNESS
They lack big game players.

PREDICTION
Brazil: 9pts
Croatia: 6pts
Cameroon 1pts
 Mexico: 1pts

No comments:

Post a Comment