Post Top Ad

Friday, August 01, 2014

BARCELONA VS REAL MADRID. WHO BIG PASS THIS SEASON?



La-liga pack stars like say na only them waka come. Them get the best player in the world, the second best in the world and them even add Suarez and James on top the ogbonge players wey dem get before. But this no be why we do this post. We want know who go best the other person for La-liga this season. Enjoy


RONALDO VS MESSI
These two form dey constant. Them never drop. This na why the best and second best player in the world go just dey rotate between these two players. Their strengths cancel out. Nobody win for this one.

BALE VS NEYMAR
These two players arrange wella. Both players get pace well well. Neymar get composure in front of goal pass Bale. But Bale get pace pass am. This two players sabi work but Naymer take style sabi pass Bale. This na why we go give Naymar and Barcelona this one.

SUAREZ VS JAMES
Suarez take head and shoulder pass James Rodriguez for this one. If no be because of Suarez biting skills, him for they rub shoulder with Ronaldo and Messi based on recent performance. Rodriguez na younger player wey get all it takes to reach Suarez level. But Suarez better pass am for now.

BARCELONA MIDFIELD VS REAL MADRID MIDFIELD
Na Inesta, Rakitik, Mascherano and Busquet vs Kross, Khedera, Modric and Isco go battle am for midfield. Barcelona arrange a little pass Madrid for midfield wey go make first eleven. But Madrid arrange pass Barcelona for depth. This na why I go say them cancel out for midfield.

DEFENSE
Real Madrid dey heads and shoulder above Barcelona for this department. All Madrid defenders and their reserve better pass Barcelona own. This na why Barcelona need better defenders. Even with Matheu wey them buy. Madrid still better pass them.
GOALKEEPER
This na another area wey Madrid take better pass Barcelona. The 3 goalkeepers for Madrid better pass the first choice goalkeeper for Barcelona. Including the new guy wey just waka come

COACH
Carlo Ancelotti better pass Jose Enrique of Barcelona. And Ancelotti get more stability pass Enrique. So we go give this department to Madrid.

CONCLUSSION
Both Clubs arrange wella. Barcelona attack arrange pass Madrid own and Madrid defense better pass Barcelona own. Both of them go fit win La-liga. But We go give La-liga to Madrid based on their current squad. Everything fit change if Barcelona arrange their defensive department.

No comments:

Post a Comment