Franchise na type of business
system wey big or more established business
go give another business (usually a small and less established ones) the right
to its products and also operate under the brand name of the big business. But
football franchise dey different because e fit assume many form. E fit assume
the conventional form wey small clubs go
pay big clubs some money to use their name and their merchandise. E fit also assume
the form wey big club go pay or support small clubs. These small clubs go
become outlets wey the big clubs go take sell their merchandize. And those big
Clubs go give the smaller clubs levels. This na some of the few reasons wey dey
make clubs do this kind of arrangement. Now, make we fast forward this matter go
the conspiracy theory wey Asrene Wenger dey talk about.
WENGER CONSPIRACY THEORY
Asene wenger believe say
Manchester City fit use the clubs wey them dey buy take avoid UEFA Financial
Fair Play rules. Make una read weiting him talk for here;
Wenger “Is it to get around the
fair play? I don’t know. It looks like all these City Clubs will feed the main
club Manchester City. I had they want to buy five clubs all over the world. I
think they want to go around the fair play with it. Arsenal will never do that
because we respect football”
WHAT MANCHESTER CITY STANDS TO GAIN
Manchester City go get other
clubs wey go serve as an outlet to market their merchandize. Them go also get
clubs wey go serve as nurseries to feed the bigger club. These gains na one of
the things wey them go gain by buying clubs in other places.
IN SUPPORT OF WENGER CONSPIRACY THEORY
Manchester City dey pay the
salary of all the staffs of New York City Football Clubs. The same club wey get
the money to pay big players salaries. This club fit loan the big players wey
them sign back to Manchester City. Make una no forget say Manchester City dey
buy all these clubs for countries wey financial fair play no dey because them dey
outside Europe.
CONCLUSION
Everybody fit talk say Wenger too dey make
noise. But the truth be say The Professor don see weitin other smaller managers
no see. This na why UEFA need to listen to Wenger and amend their Financial
Fair play rule before New York FC go sign Falcao come loan a, to Manchester
City for two years.

No comments:
Post a Comment