Post Top Ad

Wednesday, August 06, 2014

VIDAL CONVERSATION WITH JUVENTUS CONCERNING HIS MOVE TO MANCHESTER UNITED




The money wey Manchester United wan offer Juventus and Vidal dey vital to Vidal agreement to move to Manchester United and Juventus agreement to sell their priced asset. But both Juventus and Vidal no wan come out openly say the deal good for all parties involved. Them still dey hide mouth talk among themselves. Make una enjoy the 080football version of the conversation between Vidal and Juventus.


MEANWHILE FOR JUVENTUS EXECUTIVE OFFICE

Juventus: You want make we sell you to Manchester United?
Vidal: Una wan make I go to Manchester United?
Juventus: We no say we want make you leave our great club. We just want know weda you want leave our club. So make we rephrase the question. You want stay for Juventus?
Vidal: Una want make I stay for Juventus?
Juventus: If you want go Manchester United, we go reluctantly allow you to go oo
Vidal: If you want make I go Manchester United, I go reluctantly go.
Juventus: You want go Manchester United?
Vidal: Una wan make I go Manchester United?
Juventus: Why you dey answer question with question? Na we ask you first.
Vidal: I know say na una ask me first, but no be only una waka come. Make una answer one of my question na.
Juventus: We love you, but Manchester United offer us a lot of money
Vidal: I love una but Manchester United offer me a lot of money
Juventus: So e mean say you want go Manchester United..abi?
Vidal: No oo. Me I no wan say I wan go Manchester United den my oga at the top go say them no wan sell me, but na me choose to go
Juventus: Who be your oga at the top
Vidal: Una na.
Juventus: But United money too mushhh ooo.
Vidal: No be lie una talk, my weekly salary too mush
Juventus: So?
Vidal: So?
Juventus: Weitin you think?
Vidal: I no know oo. Na weitin una think?
Juventus: This discussion is going no where!
Vidal: Ohh, ok. I get it. Una say I no dey go anywhere.
Juventus: We no talk like that.

No comments:

Post a Comment