Post Top Ad

Thursday, August 14, 2014

LADIES AND GENTLEMEN, WE PRESENT THE GAME CHANGERS OF THE EPL!




Football na team sport and many goals dey come as a result of team effort. But them get some game wey go tie wrapper so tay you need a moment of brilliance from one brilliant player to change am. This na why we dey present THE GAME CHANGERS OF THE EPL! Enjoy!!


ARSENAL
Arsenal na Club wey sabi sell their players to everybody including their title rivals. Just look at City and see the array of Arsenal Stars wey dey there. But this na story of the previous seasons. Thisseason different as we see how Wenger splash the cast get Ozil and Sanchez.
SANCHEZ no go only provide pace and power to Arsenal attack. Him go provide the belief say them dey better than last season. This singular fact go make them get better result against the big boys of the EPL.
OZIL no live upto him expectation and hype last season. But him get the vision and eye to pick out the pass wey fit change any game. All him need na striker wey sabi make intelligent run.

MANCHESTER UNITED
Moyes era bring United to their knees. Van Gaal come to help them stand up and become a strong force again. This na the people wey sabi for United.

ROONEY na ogbonge game changer. Him get the strength, the technique and the power to change any game. Abeg rewind your memory to him bicycle kick against Manchester City if you no believe Rooney game changer status.

VAN PERSIE skill set dey different from Rooney. Rooney fit manufacture goal from no where with him solo run and effort. But Van Persie na goal scorer and a dangerous man when him dey near the box. This guy fit change any game to United favor.

MATA na one player wey sabi wella. We know say him no get the skill set to be Mourinho type of player. But him talent dey similar to Ozil in terms of wonderful passes, brilliant free kicks and some composed finishing.

MANCHESTER CITY
The Champions go struggle to win the EPL this time around because Clubs like Chelsea and Arsenal don dey stronger than they were last season.

AGUERO.  Una remember that solo goal against QPR? That same goal wey give Manchester City the league. This na the kind thing wey ogbonge game changer like Kun fit do if him manage to dey fit.
SILVA na another ogbonge player wey fit pick out pass from anywhere in the pitch. Him style dey exactly like Mata. Though him na the faster version of Mata.

YAYA TOURE no be the best African footballer of the year for nothing. Him sabi handle the midfield well well. And if the striker no deliver, him go deliver the goods and goals wella. This na why Manchester City catch cold when him vex about him birthday cake.

CHELSEA
Chelsea na a better Club this season because them subtract some players wey them no too need come add some ogbonge players wey them need. Them even make money on top. But that no be the main matter wey we dey discuss. 

HAZARD na the only player wey hit double figures in terms of goals for Chelsea. Him na the most fowled player in Europe in the last three seasons and na him be one of the best creators in the world. Hazard fit score solo goals wella as we see against Liverpool and Westham.

COSTA go be one of the Super players for Chelsea this and other coming seasons. Him na the major game changer for Atletico Madrid last season. Him go naturally be one of the game changers for Chelsea this time around

FABREGAS sabi score, him sabi assist, sabi change the course of the game within seconds due to him good vision, skill set and wonderful technique. Him go be one of the main guys for EPL this season.

This na some of the game changers of the EPL this season. We go talk about LIVERPOOL in our subsequent editions about GAME CHANGERS. Until then, make una stay out of trouble.

No comments:

Post a Comment