This transfer window don dey waka pass and many clubs dey
claim say them don buy their market finish. This na why we dey analyze the clubs
wey buy good market, and the ones wey buy bad market. We do this analyses with
respect to the players wey the clubs buy and the ones wey them sell. We no
consider the clubs wey still dey for market. Na only the clubs where their
coach say them no dey buy any player again na him we consider. Make una enjoy.
LA-LIGA WINNERS
REAL MADRID na
the winners in La-liga. Them first sort out their goalkeeper wahala by selling
Lopez to AC Milan after them bring Karlor Navas to provide competition to
Casilas. Them buy Toni Kroos cheap and the best young player for him position
from Monaco wey be James Rodriguez.
LOSERS
BARCELONA go try
adapt to new coach, new style, new formation and new players. Luis Enrique wan
use 3 defenders with two strong defensive midfielders. Him buy injured Thomas
Vermalelen and 31 year old Jeremy Mathieu. Suarez self go miss plenty games wey
fit bit Barcelona. Even though Rakitick sabi play ball, but players outside
Barcelona dey always find am difficult to adapt. Him sell Sanchez and Fabregas.
The goalkeeper wey them buy (Cladio Bravo) dey make plenty mistakes. This na
why everybody dey ask why Barcelona no go for
goalkeepers like Cech and maybe
Lopez.
EPL
WINNERS
CHELSEA na the
major winners for EPL. Them add three players for the position wey them need
reinforcements and improvement. These three players go waka come their first
eleven like say na only them waka come. Fabregas, Costa and Luis don turn
Chelsea from the little horse wey dey learn how to jump to the big horse wey
fit carry Mourinho go war.
LOSERS
LIVERPOOL replace
their highest goal scorer with Origi, Lambert and many other players from
Southampton. We still never understand how Rogers think say players wey help
Southampton finish 7th go fit help win the EPL. We also expect an
overhauling of the defense with only skrtel
remaining. But na only one defender
waka come for this transfer window
SERIA A
WINNERS
LAZIO do better business among the Seria A clubs.
Them make sure say them no change coach or sell players like Miroslav Klose,
Antonio Candreva and the wonder kid wey him name na Balde Diao. Them also add players
like Marco Parolo, Dusan Basta, prolific striker wey him name na Filip
Djordjevic and Vrij wey do very well for
Netherlands in the world cup.
LOSERS

No comments:
Post a Comment