Post Top Ad

Tuesday, August 19, 2014

OFF FOOTY THINGZ: ABEG NA WHICH CLUB SNOOP DOG DEY SUPPORT?



Manchester United great, Eric Cantona no get Snoop Dog for mind when him talk say “A person can change his name, his spouse and everything in their life. But never their football club. ” well, fast forward football till you reach hip hop and see as Snoop Dog wear Manchester United, Arsenal, Liverpool, Ajax, AC Milan and Barcelona shirts.


STARS AND THE CLUB THEY SUPPORT
Tonto Dike and PSquare na Chelsea fans. Rugged Man and Yinka na Manchester United fan. Melvin na Arsenal fan and Area Father na Enyimba football club of Aba him dey represent. All these fans dey always stay true to the clubs wey them dey support, you no go ever see them for another club jersey…but Snoop Dog get different idea.

Snoop dog fit no be everybody main man as far as music is concerned. But you fit always bet on him supporting your club. E no even matter the club wey you dey support. We even believe say him dey Support Kano Pillars and Enyimba sef. 

No comments:

Post a Comment