Post Top Ad

Friday, September 12, 2014

INTERNATIONAL BREAK DON WAKA GO. CLUB FOOTBALL DON WAKA COME.



Na a mixture of anger and disappointment for this international break because we watch our ogbonge Super Eagles fumbled and floundered as them draw South Africa after them loose against Congo. This na why every Naija person go want make weekend club football come sharp sharp. This na why we dey tell una say welcome to weekend football! Some of the plenty things wey go happen for this weekend na:


ARSENAL VS MANCHESTER CITY
The Gunners rolled a depleted Manchester City aside when them arrange them for the Community shield. But City strength don come back even though them allow Stoke City shock them for their home. Arsenal go also play their new boys Sanchez, Chambers and Welbeck and everybody go see how them go perform against the big boys like Manchester City. City also wan collect their FA pound of flesh and even prove say them no be pushovers after their shock defeat against Stock City. This match na ogbonge one. Don’t miss it.

REAL MADRID VS  ATLETICO MADRID
This match na between Champions League champions and La-Liga and Europa champions. This na a very huge ogadagidi match. Real Madrid don already collect from Atletico this season.  And we go see how Madrid new boys go fare against the big boys of La-Liga.

EXCITING THINGS TO WATCH THIS WEEKEND
  •         FALCAO go make him debut this weekend
  •         Welbeck go make him debut as an Arsenal player this weekend
  •         Sagna go play against him former club this weekend
  •         Remy fit make him debut for Chelsea this weekend
  •         Chelsea go host inform Swansea for Stamford Bridge this weekend
  •         Rio Ferdinand go play against him Old Club Manchester United this weekend
  •         Juventus go host Udinese

All these na the weekend footy happenings for una footballtainment. Enjoy!

No comments:

Post a Comment