Post Top Ad

Wednesday, October 15, 2014

080FOOTBALL MATCH DAY PREVIEW: NIGERIA VS SUDAN



Before before, Nigerians no dey worry about countries like Sudan. But those days dey behind us as we watch how Sudan tactically clipped the wings of our ogbonge Eagles to the point wey them no fit fly. This na why we dey touch light the 
Nigeria vs Sudan match.

TEAM NEWS
We expect Naija coach to make some changes for today’s lineup as Ahmed Musa join the recuperating Babatunde for the injury list. Na Hull City Omatsone go replace am for the starting lineup. Another person wey fit no play/start due to injury na Elderson Echiejile. The complete lineup na Enyeama; Oshaniwa, Oboabona, Omeruo, Ambrose; Onazi, Mikel, Lawal; Salami, Emenike, Aluko. Many Nigerians go dey ask where Uche, Martins and Kelechi Iheanacho dey. But that one na oga Keshi headache, no be our own.

STRIKER WAHALA
The rain wey dey fall for opposition defense don stop. Now na goal drought Nigerians dey experience as our ogbonge strikers wey dey score for fun no longer know how to find the back og the net. This na why Nigerians dey ask Keshi to bring back inform Uche or Martins to the National team to partner Emenike. Especially as Ahmed Musa get injury.

THE MIDFIELD
E dey difficult to understand Oga Keshi . Especially when the midfield dey concerned. Keshi don use Mikel for both defensive and attacking midfield and many Nigerians go dey hope say THE REAL MIKEL OBI go stand up and be counted. Him don dey below per since him man-of-the-match performance against Iran for world cup. Mikel go partner Aluko and maybe Nosa Igiebor if him no want play Liverpool starlet, Hope Akpan because him dey too young for this kind of match.

DEFENSE
Nigerians body no totori them as them watch how their defense crumble when Sudan attack. Enyeama presence no even stop Sudan as them breach our defense. This na why Oga Keshi need to use Mourinho super glue take fortify our defense. Afe Ambrose no too try when Sudan host us, but we want believe say na bad day him experience. We also want believe say him go turn up for today’s game. 

No comments:

Post a Comment