Chelsea 6-0
win against Maribor come with some wahala like Remy injury. Costa also dey
injured leaving Mourinho with the option to choose between between Drogba and
Dominic Solanke. E dey difficult for a 36year old Drogba wey play 75mins on Tuesday
to play 90mins on Sunday against Manchester United. This na why we feel say
Mourinho fit give Solanke the chance to shine. Make una read on to know a thing
or two about Naija boi Solanke.
Solanke wey
get Naija papa and British mama join Chelsea when him dey 7 years old. Him come
graduate from under 13, under 16, under 18, under 21 and now him dey run things
with the senior team. Like Victor Moses, Solanke don represent England for
under 17 and under 20 world cup. Where him be the joint highest goal scorer.
Him also dey under 21 for England and some peps dey even say him go gree play
for Nigeria if we invite am. Solanke scored 20 goals last season for Chelsea
under 21. And him score 25 goals last two seasons for Chelsea under 18. This na
why Mourinho say make them blame am if Solanke no grow to become ogbonge player
in the next coming years. This na why him put am against Maribor for Champions
league.
Solanke captained Chelsea Under 18 to the U21 EPL title
7 and 19 year old Solanke with John Terry
Solanke first game at Chelsea vs Maribor in the Champions League
Solanke with Maribor players





No comments:
Post a Comment