Post Top Ad

Wednesday, January 07, 2015

THE NU MELTDOWN AT BARCELONA AND WHY ENRIQUE AND CLUB CHAIRMAN SHOULD BE BLAMED!

Lionel Messi started Barcelona's defeat at Real Sociedad on the bench and has fallen out with Luis Enrique

When Real Sociedad scored against Barcelona just after one minute on Sunday night, TV cameras honed and zoomed their lens on 200 million pounds worth of players on Barcelona bench. Many of these players no dey in speaking terms with Enrique and the club chairman dull to sanction the sales of ogbonge players like Sanchez and Fabregas wey dey loyal. These na weiting 080football dey touchlight so. Make una enjoy.

THE SINS OF ENRIQUE
Enrique is under pressure after leaving almost £200m worth of talent on the bench against Real Sociedad
Oga Enrique leave plenty players for bench even though serious match no dey

Enrique man-management style no good at all as all the major players no dey in talking terms with him. This matter remind us of AVB when him dey for Chelsea. The difference be say Enrique get previous terrible man-management issues before. Him bin get beef with Daniel Di Rossi and Fransico Totti for Roma and now him come get beef with Messi and some other super stars.

BARCELONA CHAIRMAN FALL HAND

We know say Suarez sabi wella. But him for no sanction Suarez buy at the expense of another similar player (Sanchez). Especially if una consider all the baggage wey Suarez carry come Barcelona. And the sale of Fabregas na another thing wey dey scatter the head of most barca fans. Him (Fabregas) replacement dey heads and shoulder shorter than Fabregas in every playing department.  This na why we never understand the 080logic behind the sale of Fabregas and even Sanchez.

THE NU MELTDOWN
Abi Oga Messi want port?


Puyol don hand in him resignation and Barcelona don accept am. Moyes use Barcelona re-lunch him dream carrier after him Manchester United nightmare. Suarez (Sanchez replacement) no dey score and Sanchez dey score wella. Messi no dey happy and unlike Yaya Toure wey dey shout “Manchester City no give me my birthday cake”, Messi no even talk anything. Him dey silent just dey follow everything wey resemble Chelsea for social media. 

Barcelona need to employ the company wey get the best damage control strategy if them want come out of this casala unscathed. Otherwise, these series of wahala go affect them on and off the pitch.  

No comments:

Post a Comment