Sanchez, Ozil, Carzola, Theo Walcott, Giroud and Podolski
dey enough to scare any opposition defense. This na why we dey start our “LETS
TALK ABOUT A CLUB” with Arsenal. Sit down. Cross your legs and enjoy as we talk
about weitin we dey expect from Arsenal this season.
THE RETURN OF THE
FALSE NINE
If Arsenal no sign another striker this season, them go
resort to the false nine movement anytime wey them want change their
conventional tactics. As we all know, Sanchez and Walcott bam in front of goal pass Girud. This
na why we go see more of the false nine with Walcott and Sanchez leading the
line. This approach go provide plenty tactical flexibility to Arsenal game
plan. Make una no forget say Spain, Barcelona and Bayern use false nine take
achieve better result.
MIDFIELD
Arsenal need a defensive midfielder if them wan truly challenge
for more than the title this coming season. We say this because Arteta go tire
if Arsenal play more than one game a week towards the tail end of the season. The
only way wey Arsenal go win the EPL na to comot from other competition early.
Or to use their academy players in those competition. But their current
midfielders bam enough to win the epl title
DEFENSE
6-0 against Chelsea, 6-3 against Manchester City, 5-1
Liverpool. We all expect Arsenal to go for a better defender wey go play
alongside their own ogbonge defender. Par Martesecker and Vamalain dey a little
bit above average and this na why them dey concede unnecessary goals wey dey
always cancel out the goals wey their strikers score. Arsenal go leak goals if
them no get another defender and maybe another defensive midfielders.
GOALKEEPER
Arsenal don sort their goalie wahala with the signing of Ospina.
So this area dey covered.
CONCLUSION
Arsenal go do better this season because them add more and
better player than the ones wey them get last season. But them need to add a
defensive midfielder and a defender if them want because serious title
contender.
JUST IN: Chambers don sign for Arsenal for the amount wey be undisclosed. Arsenal don dey arrange their defensive worries, E remain their defensive midfield wahala. Good job Wenger.

No comments:
Post a Comment