If all the done deals, medicals, transfer news and rumors wey
we dey hear na true, Falcao and Cavani for dey play for Chelsea now, Fabregas and
Cristiano Ronaldo for dey United since last season, Arsenal for don sign the
next Messi, the next Ronaldo and the next best footballer wey dey for this
world. Even Barcelona for don sign David Luiz and Real Madrid for don sign
Messi. But them no be true. This na why we wan give una some info on how all these
rumors dey take spread.
MEDIA HOUSES
Newspapers, TV Stations, Magazines and Sport blogs need
contents. So na natural thing to start the kind of rumor wey go dey
interesting to everybody. This na why we hear news like HAZARD TO PSG A DONE
DEAL. Only for Hazard to come out say him and Chelsea wan agree new contract. We
also hear say Barcelona wan sign Ramsey before the player come deny the
speculation. So media houses fabricate sensational news to get the attention of
their audience. More audience, more money and akpalakpala from adverts.
AGENTS
All agents get insiders for every media house wey dey this
world for good PR reasons. So them dey use these media houses spray false news
when them want the following; Them want make the Club give their client new contract
and salary increase, Them want make other clubs dey interested for their
client, them want create news say their client sabi wella wey make big clubs
dey interested. This plan no dey work well all the time as we all know when
Arsenal Niklas Bentner say Real Madrid and Barcelona want am. Only for him to
still dey clubless even though say him na free agent after Arsenal release am.
PLAYER RELATIVES AND
FRIENDS
Everybody know the media buzz wey surround Suarez when
him father say him want make him son play for Real Madrid. We also know weitin
happen when Hazard wife say she love Paris. Every media house wey dey the
world translate am to mean; “Hazard on his way to PSG as wife confirms move”.
REAL NEWS
The real news dey always start as rumors, but them no dey always dey sensational like the fake ones. When news agencies like the bbc's and the cnn’s of this world start to dey report news about a player. You go know say the news fit be
true. Another news agency wey dey try small na sky sports… and 080football. Yes we too much. You go also know say na REAL NEWS when the news come
from the player himself, the manager of the club wey want buy am, the manager
of the club where him wan comot from and the official confirmation say the club
don buy or sell the player wey dey involved for the news.
This na how to sieve transfer news.

No comments:
Post a Comment